February by Nick Nwaogu - HTML preview

PLEASE NOTE: This is an HTML preview only and some elements such as links or page numbers may be incorrect.
Download the book in PDF, ePub, Kindle for a complete version.

TEGA (CONT'D)

 

How much be your salary? You dey find girlfriend. You no see all these local girls wey dey sell food for canteen, na fine girl wey go university you dey find. You go university? I dey ask you, you go university?

 

KUNLE (to Tega)

 

Let her answer. Are you her spokesman now?

 

TEGA (to Chioma)

Oya, answer.

 

Chioma is still laughing, staring away from the pair. An ELDERLY Woman, probably in her 60s, dressed in YORUBA native ATTIRE walks into the INCIDENT ROOM, through the main entrance of the building.

 

ELDERLY WOMAN

 

(to Tega; at the counter) Oga Police, I wan bail my pikin.

 

TEGA

 

Who be your pikin? Wetin be the name?

 

ELDERLY WOMAN

 

Yinka... Yinka Adekunle.

 

TEGA (re: Suspect)

 

Oh that boy wey say him go collect him money from where them dey smoke weed!

 

(to Elderly Woman) Madam your money na twenty thousand. No abeg.

 

ELDERLY WOMAN (sobs; in Yoruba)

 

Ah! Jowo. Ran mi lowo. Emi ni a opo. Egba mi o. Jo.

 

Screen Translation:

Please. Help me. I am a widow.

Help. Please.

 

TEGA

 

(to Kunle; re: Elderly Woman)

Na wetin she dey talk so?